Jokes About Poverty by Gordons




Anywhere you see poverty, jump pass am. We were so poor even the poor people dey call us poor.
I remember when I wan go marry, I meet my father-in-law, as the man see my outlook, he ask, “Are you he that is to marry my daughter or should we wait for another?”


Na him I tell am say- “I am he” he ask me, “Who is your father?”


I ask am “biological or spiritual?”






The guy say biological. Na him I tell say, oga na only spiritual I get. Why because when the guy see me, the way I look, him talk say him no like my future.


When I wan meet another in-law, I don first get info about the man, dem say the man like bankers ( wear suit, dress well).




Me wey I never wear coat before, I go for okirika joint go collect coat. When I look myself for mirror, coat be like bed sheet.
Na him I dress go meet my in-law, as soon as he see me, he say “Nice-nice”.


I said “yes-yes”


He asked “So which of the banks do you work?”


Na him I say, “Savannah State”


He ask me, “Is that a new bank?”


I said, “Yes, Savannah merged with Allstates”


Na him, the guy look me say, “I no get pikin wey I go give to somebody like you”.


Na him I provoke go meet my father ask am, “where you dey when all these men dey huzzle wey you fit huzzle, now dem don deny me wife”


Category: Humor & Jokes



You May Also Like:



No comments

Powered by Blogger.